Late Nigerian bank mogul Herbert Wigwe funeral start wit 'emotional' night of tributes - iReporter News Network | No #1 News Network in the world.

Post Top Ad

Late Nigerian bank mogul Herbert Wigwe funeral start wit 'emotional' night of tributes

Late Nigerian bank mogul Herbert Wigwe funeral start wit 'emotional' night of tributes

Share This


Di burial rites of former CEO of Access Bank Holdings, Herbert Wigwe, im wife Chizoba and son Chizi don start.


Di programme of events wey di family bring out, start on Monday for Lagos, Nigeria commercial capital.


Dem call di first day of di event 'Herbert Wigwe: Celebrating Professional Excellence'.


Many ogbonge pipo including govnor of Nigeria highest bank, richest black man in di world, oga of Afrexim Bank and many, state govnor, goment officials, stakeholders and pipo from di business industry attend di night of tributes of di di Nigerian businessman.


Access Holdings announce di death of dia Group Chief Executive Officer, Dr Herbert Wigwe last month. Dem say e die for one helicopter accident for America.




Govnor of di Central Bank of Nigeria, Yemi Cardoso tok say im get di opportunity to interact wit Herbert for di last few months and Herbert bin visit am two times.

"Im concern show about how im fit help to reduce di challenges wey di Nigeria economy bin dey face.

"I go kontinu to value di professional contributions im make for our meetings and also appreciate how insightful and thoughtful dem be."

Yemi Cardoso say on of di memories of late Herbert Wigwe beyond business na im involvement for di National Arts Theatre project.

"E get genuine concern for di welfare of our nation and di pipo"

Dangote shed tears as e pay tribute to im 'mentee'

Anoda ogonge business man, wey also be one of di richest men for Africa, Aliko Dangote showface for di night of tributes.

E describe di late Herbert Wigwe as im "broda and loyal friend".

"Herbert na visionary leader and perfectionist wey give so much of imsef, even though im no dey hia wit us again, we dey see im transformative stride all over our economic landscape and even di world".

Among all oda good tins , im bin be a pillar of strength and support for me, my family and our business dem.

Im no dey tire to comot from im comfort zone to tie all di knots for our company as we begin to grow.

Im dey proud to be part of my success story and I also dey proud to call am my devoted friend and broda. E dey hard to find anoda Herbert" Dangote explain.

Dangote shed tears wen im tok say im owe Hetbert plenti 'thank you' and even though Herbert no join military, im dey very courageous.

'Time bin stand still in honour of Herbert Wigwe' - Aig

Ogbonge pipo for di business industry showface for di night of tributes. One of dem na Aigboje Aig-Imoukhuede.

Aigboje Aig-Imoukhuede wey be Nigerian banker, businessman and investor cry as im pay tribute to im friend.

For im tribute im tok say time bin stand still wen im friend and brother comot from dis world last month.

"My broda and partner Hertbert tok publicly about im belief say time no dey wait for anybody.

Herbert live im life like pesin wey dey on a mission wey get short time to complete im work.

Even though im be man wey be di best of di best Herbert still dey worry if im get enough time to achieve all im dream.

As di tori about dis accident start to spread across di world time bin stand still in honour of Herbert Wigwe".

Herbert Wigwe death make all of us as human beings to reflect on our collective humanity.

Herbert death make millions of pipo wey sabi am and anoda hundreds of millions of pipo wey no sabi am at all, make dem to tink about di African leader and to understand di full potential of wetin im bin wan do for humanity.

Im death also make di world know say Africa fit still produce outstanding men and women."

Aig add say even though Herbert, im wife and son die, di way dem take honour am no be wetin dem dey see evritime for Nigeria history

Oda pipo wey tok for di night of tributes na President of di Africa Development Bank Group, Akinwumi Adeshina.

E say "Evritin wey Herbert touch dey turn to gold.

Govnor of Lagos state, Babajide Sanwo-Olu add say di late Herbert Wigwe 'Dey Completely detribalised; Lagos no go forget Herbert Wigwe,'

Nigeria Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy Wale Edun describe di late Herbert Wigwe as "Pesin wey get plenti ideas and dey creative for im thinking".

Herbert Wigwe, im wife and son die on 9 February, 2024 for helicopter crash.

Na for United States wey di plan crash as dem bin dey go di Super Bowl LVIII championship for Las Vegas.

Authorities say bad weda affect di helicopter wey kill all passengers on board including di two pilots.

Full burial programme

Di burial programme schedule go run for seven days according to di family. E go end wit Outing service on Sunday 10 March, 2024

Celebrating Chizi Wigwe

Tuesday, March 5, 2024

Celebrating Chizoba Wigwe

Tuesday, March 5, 2024

Night of Tributes

Wednesday, March 6, 2024

Combined Service of Songs

Thursday, March 7, 2024

RCCG, Ressurection Parish,

Christian Wake-Keeping

Friday, March 8, 2024

Wigwe University, Isiokpo

Combined Funeral Service

Saturday, March 9, 2024

Private Interment Ceremony

Saturday, March 9, 2024

Outing Service

Sunday, March 10, 2024

RCCG, Lion of Judah Parish, Isiokpo



Source: BBC Pidgin

Copyright IREPORTER NEWS.

All rights reserved. This material, and other digital content on this website, may not be reproduced, published, broadcast, rewritten or redistributed in whole or in part without prior express written permission from iREPORTER NEWS.

Contact: ireporterng@gmail.com

No comments:

Post a Comment

Subscribe to our publication. Do not miss out on any information.

Join us on Facebook:
https://facebook.com/ireporterinternational

Follow us on Twitter:
https://twitter.com/ireporterng

Post Bottom Ad